Watch Precious and Osagie: Danger at every turn For Precious and Osagie, life for Naija begin to dey somehow when herdsmen begin to dey cari deir cattle go chop Osagie crop for farm. The community begin enta fight with di herdsmen but tension con dey, so di community no dey safe for dem again. Osagie decide say hin go travu go Libya with one friend wen promise to sponsor hin waka. Precious later decide to join, so she meet someone wey promise her house geh work for Libya. The desert joni no easy, na for dere regret begin dey enta their mata.
Watch Mary: The school that was a brothel Fight happun for Mary village and dem kill her family, but she manage to escape. She later meet one woman wey offer to take her go Europe to work as housemaid. She promise her say she go also go school for dere. Mary agree and dem begin di waka. When dem reach desert, soldiers begin shoot deir car and di tin overturn sotey e injure many passengers. Dem even begin to dey hide upandan with very little food and wota. Pipo come become desparate asper hunger and no wota. Na until 10 days later anoda car come cari dem comot for dere.
Watch Gloria: Sold in a slave market Gloria lose her business for Naija and her creditors begin to harass her. One friend tell her about di joni to Europe as a way to make moni, and so dem enta di Libya road. Di joni through di desert harsh wella, dem suffer from heat taya, plus hunger and thirst. Wen dem reach Libya nai dem con find out say na lie dem take trakke dem enta road, because di truth come be say na sell dem cari dem con sell. Since dat day Gloria no see her friend again.
Watch Favour: Don’t take that road! Favor been dey prepare for her wedding for village when problem happun and she need to escape for her life. Her brother kill her stepmother and di family of the stepmother say dem go collet revenge for Favor body. Favor see no oda option dan to escape. Someone been don yarn her before say work dey Libya so she folo enta road. But di waka no be here!
Watch Shola: Escaping slavery, ending up in jail Shola been no happy with her life for Naija. She been wan study to get job but when she finish secondary school, her family don expet say di next tin na to marry, born pikin and become housewife. So she decide to go Europe for beta life. One woman promise to take her dere and she folo go with a group of girls. Dem been don promise dem say di joni go dey short and easy but dem con begin dey experience am say di crossing of di hot desert to Libya be like nightmare.
Watch Vera: Abandoned in Libya, kidnapped by gangsters For university for Naija, gangsters been dey threaten Vera and her brother sotey di situation con become dangerous and her mama begin worry about her security. Vera begin feel like say she no get any oda choice dan to run comot for di countri. She contact one smuggler wey promise say e go fit cari her go Europe. Di woman tell her say she fit earn money for Libya and for Europe as ashawo but Vera tok say she no go do dat kain tin and di woman tok say ok. But na when dem reach Libya di woman come begin show her true color dey tok say she must do ashawo to take pay di money wey she owe.
Watch Franca: They are selling their girlfriends For Franca tribe for naija, dem dey circumcise women wen dem don reach a certain age. Franca been no wan make dem circumsize her so she run comot for house. She decide to go Libya go find work for dere. As she reach Libya, she realize say life for dere brutal and wetin she been expect no be wetin she meet for dere. She find out say Libya na dangerous place, especially for women.
Watch Ifeoma: Risking your life in Libya Wen Ifeoma business fail for Naija, she enta gbese, sotey her husband pushu her comot for house. Di whole situation con land her inside desperate kwanta until she con meet one woman wen tell her say she fit cari her go Libya go work as house geh. Ifeoma been see dis as beta opportunity to pay off her gbese, so she folo waka. But di joni no come dey as she take expet am.