Wen Ifeoma business fail for Naija, she enta gbese, sotey her husband pushu her comot for house. Di whole situation con land her inside desperate kwanta until she con meet one woman wen tell her say she fit cari her go Libya go work as house geh. Ifeoma been see dis as beta opportunity to pay off her gbese, so she folo waka. But di joni no come dey as she take expet am.
When I enta di joni, we enta desert, we start suffering we cry with pain for road. One, dem load us for hilus as dem dey load ice fish for carton. Dat is di first experience. Di second one, dey don't have pity for human beings, they run like they are flying many pipo die for road"
After Ifeoma enta Libya, she find job as house geh. She been like di work because di family wen she work dey pay her, but di situation for Libya con dey worse and e no con safe again to dey dere.
"Libya na place wey be say you no go get rest of mind one day. If you dey Libya, you cannot sleep with two eyes. One day, April 2018; dey start shooting bomb, they start shooting gun. So dos pipo call me say dem wan go back to deir village because dem dey bomb many house dere, and I no get house wen I go go stay"
At first she been no think am say she wan enta Europe, but as di mata con take be, Libya con become dangerous place to stay. Later some friends con offer her to join enta boat follow smugglers go Europe. As dem dey go, dem spend three days for sea. Di boat con begin dey sink. Na one fisherman con later see dem begin call Libyan coast guard, but before di coast guide arrive, Malta ship rescue dem comot for di wota cari dem enta Malta. Ifeoma tok say if she been know how dangerous di joni go take be, she for no folo dem enta. She dey warn oda pipo so dem go know di kind risk wey dey di road if dem enta.