Watch Vanessa’s Story: A journey through hell “Den drag di baby comot for my hand. Den push us, den say make we enter hilux ”Make you watch Vanessa’s heart-breaking tori about her waka tru Libya to Europe. Nor believe any kwe kwe trafficker promise!
Watch Frank, Blessing and Isibor discuss wetin deir eye see afta dem comot for Naija Three Naija men for one migrant centre share deir tory with eachoda. Dem come from different background and get different situation but all of dem travu go Europe thru di same route: Sahara Desert to Libya and las las across di Mediterranean Sea.
Watch Caroline’s story Caroline mama die di day wen den born her, and wen her papa hear di news, heart attack kill am. Wen Caroline reach 12 years old, her caretaker finally tell her say she no get mama and papa. Na for dere Caroline con jam one woman wen cari her go her village to find her true true relative. But afta fight happun for her village, tins get as e be, and life con hard. Na di guy wen Caroline dey date con tell her say hin sista get supamarket for Europe and e fit arrange corret job for her for dere.
Watch Telling the Real Story Trailer 2020 (Nigeria) Watch dis trailer make you for learn about Telling the Real Story, Nigeria.