Watch
Sex Slavery in Europe
Inside dis video, seven naija women wen escape ashawo work for Italy explain di horror why dem meet when dem reach Europe. Before dem comot for naija dem tell dem say dem go get decent job as cleaner, or as sales girls for shop, or even as house geh. But di madam wen cari dem reach Europe force dem enta ashawo work. Anytime wen dem refuse dem beat dem and threaten dem say den go die becuz before dem comot for Naija, dem been don take oath say dem no go run from any job wen dem give dem for Europe.