Caroline mama die di day wen den born her, and wen her papa hear di news, heart attack kill am. Wen Caroline reach 12 years old, her caretaker finally tell her say she no get mama and papa.
Na for dere Caroline con jam one woman wen cari her go her village to find her true true relative. But afta fight happun for her village, tins get as e be, and life con hard. Na di guy wen Caroline dey date con tell her say hin sista get supamarket for Europe and e fit arrange corret job for her for dere.
"E con call one woman say make e con carry me. As we reach Qatrun (Libya), e con handle me give one man. He say na moni e take cari mi for hin hand say I need to pay back di moni"
Caroline been fall inside trap. Just like many oda Naija women wen dey desperate for beta life, she sef believe di tory say beta work dey wait her for Europe. Instead, na style den use kidnap her go do ashawo for Libya by fire by force.
She say lai lai she no owe anybodi moni but den no gree. Las las den cari Caroline go brothel for Tripoli where dem begin mistreat her. Unto say she must pay de money, den force her to dey sleep with different different men, and anytime wen she refuse, no be small beating.
One day, pipo with gun attack di place wen Caroline dey work. Den cari her and oda pipo go jail, but na dat jail con hard pass sotey de tin be like frypan to faya. Inside jail, den just dey abuse women upandan.
"As in, they maltreat use like animal. We no be anything. Den go dey beat us from morning to night, den go still dey fuck us. No food, no water, nothing"
Di whole tin be like hell faya. Caroline take her eye see as women and children dey die from abuse and neglect. Women cari belle inside jail, den still born inside dat same jail. After six month for inside jail, Caroline manage to escape wen boys dig hole for wall, but before she open her eye anoda group don capture her again go inside anoda jail and begin abuse and rape her until las las she get belle.
Again Caroline escape and dis time she get luck say she see pipo wen dey enta boat to cross sea enta Europe. After de sea joni begin, due to overload of pipo, wota begin dey enta inside deir boat. Pipo jampack full inside di boat, in fact den sidon ontop eachoda sotey Caroline lose her belle and blood begin full everywhere. 15 hours later for untop wota, den finally see rescue, but at dis point, Caroline been don already dey for very bad condition. Now Caroline dey one reception centre for Italy, she explain her tory give us.
"Me myself I no know say na Libya den dey cari me dey come. Den kidnap me come, den use me take chop money. And di moni wen I dey talk now, na my body nai I take work an. If I know say na so di contri be, I for no come"