Janet run comot for her village for naija when she dey 12 years old becuz her stepmother dey wicked her. In order to survive, she begin dey do kwe kwe jobs for inside farm and later she con move go Lagos where she con begin dey do nanny. One day she jam one woman wey con promise her job for South Africa on di condition say she go swear say — if she run sometin go do her. As Janet think say she don see solution to all her problem, she gree.
“I con been think say na beta work, so I con agree say e even beta pass dis one wen I dey do so. So I con agree to go. E still cari me go another place where dem collet my pant, den con collect hair for my armpit, even for my private part. Dem say if I run comot dem go use di hair do something wen be say I go fit dey mad".
Nai Janet con begin di joni. Di smuggler cari her pass Niger and di Libya desert. But unto say Janet no know road, she no kaku until she reach Libya — say na Europe den dey cari her go, no be South Africa. Di joni tru desert hard gan. Dead pipo jus dey road anyhow. As dem dey go, nai bandits ambush dem and when dem tok say dem no get moni, den begin rape Janet and di oda gehs. Later den come even beat dem join.
When den reach Tripoli, some pipo con arrest dem dey rape dem upandan. When den con finally release Janet, dem cari her go desert go enta boat go Europe. Janet don hear before say dat sea dangerous so she begin fear for her life.
“So I dey think say na so I wan take lost my life, na so I wan take go like that, upon all the suffer way I don suffer? I say I no go go, den say if I no go I go rotten for dis camp"
Dem pack dem put inside small balloon boat, na real nightmare. Pipo con dey sick as dem just dey untop di sea becos di sea just dey cari dem upandan. Las las dem com see rescue wen rescue dem go reception centre for Sicily. When Janet reach Sicily nai person call Janet say she be sister to di woman wen send am come. She say make Janet dey come, na so Janet leave reception centre go meet her.
As I reach dere, she say "you remember all dos pant wen we collect from you" I say yes, den she say "work no dey here o. I go cari you go market go buy you cloth way you go take dey hustle". She say I no fit comot again, say if I comot, all dos tins way dem take from me, den go use am against me. I come dey fear make I no go mad
Janet believe say she no get choice so she gree, especially when di woman con tok say she owe 30,000 Euro. Na so Janet begin dey work as ashawo, but afta 3 month she no fit take am again, so she run leave di job enta Germany. Janet don dey Germany now and she still dey fear due to di swear wen she swear before she comot for naija. Janet dey share her story so dat oda women no go fall victim enta inside desame trap as her.