Three Naija men for one migrant centre share deir tory with eachoda. Dem come from different background and get different situation but all of dem travu go Europe thru di same route: Sahara Desert to Libya and las las across di Mediterranean Sea. Dem also experience similar violence, desperation and sufferhead.
Frank, Blessing, and Isibor comot for naija because dem been dey find beta opportunity and security. When dem dey Naija, Frank been work as mechanic and Isibor been work as welder. Both of dem face harassment for gang hand, sotey di situation make deir life and business hard. As dem hear say Libya na korret place to take make beta moni, dem decide to travu go work for dere. Blessing been dey do jack of all trade for Naija - unto say hin be cameraman, painter, barber, but hand still no reach mouth. He comot for Naija because hin dream na to get korret stable job for Europe, and for hin eye dat time, na Libya way sure pass. But wetin dey await dese three men no be for here!
Time for Libya
ISIBOR: “I say make me comot for Nigeria mai still go Libya mai still go work dere because I dey hear Libya, den say Libya good. Den never tell me about bad Libya before. I enter Libya, no be as I think am, no be so Libya come be o. Den still dey purshu me upandan, everyday beating"
FRANK: "I run to come Libya to come start anoda different life but when I come to Libya I con see say na l.ibya life nai con even worse pass. Even wen I come to Libya, thru out di 8 months wen I spend for libya, na prison I take am go. den go cari me sell me to dis one, afta I pay... 'okay driver carry me to to my camp', den go also go sell me to another man again"
BLESSING: "Me now dem no sell me for Libya but I work free work for Libya"
To survive deir enslavement and suffered, di three of dem escape Libya cross wota enta Italy. Although frank and isobar been no plan to enta Europe but condition for Libya no easy. Jus like many odas wen dey cross, Blessing cross dat wota untop credit wen e go still need to pay back to di people wen traffic am. Las las, as dem reach Europe, na anoda disappointment dem meet - den con see am say di europe wen dem dey come no be di paradise wen dem been expect say e go be.
As dem reach Europe
ISIBOR: “Now me I reach Europe hoping say I go get job jus now. I don waka waka waka, okay where job dey? Now people dey tell me say 'bros work no dey o'. I con dey ask dem say how una take dey do am, den say "bros, na begging o". Myself wen get work before, I come shock, wetin I never do for my kontri before!"
BLESSING: “People dey quarrel with me say why me no dey go do begging. Because for my side, you know Nigeria na, na people wey no complete na dem dey beg"
FRANK: “Even my first son don grow, my daughter don grow, na university dem wan enta now. But my wife dey call me now say see your first son wan enta school o, di second one wan enta school o. Where di moni, where di work dey?"
Di future
Di three of dem gree say di Naija pipo wen dey abroad sef dey responsibe for di reason why many pipo wan travu go Europe. As dem go dey post picture for social media about di enjoyment wen dey Europe, dem dey paint fake picture of di reality and dey cause make oda pipo dey waste deir time, money and also deir health. Three of dem also agree say e go good make all dose things stop because, nai dey cause make many people risk deir life, and di only pipo wen dey benefit na traffickers and also all dos bandits wen dey kolobi pipo for inside desert.
BLESSING: “Post motor wen no be your own, house why no be your own. All dos tins nai still dey deceive our pipo for dat Africa so"
ISIBOR: “As you post an for Facebook dem go say 'all dis boys so dem don get moni finish for Europe'. So di moni wey everybody dey gather say 'i gada dis so so amount o, wan enta road', just find small tin, no be say you wan risk your life for Libya.