– LORETTAI no know as I go take describe an, because if I think about it, e dey scatter my head. I just dey pray say how to repackage my life back because if I just take my life put for mirror, e be like a broken pieces.
– RITAFor night bad bad dream, I was dreaming say many things. Bad dreams, I was dream say I was walking from dead people, from grave.
Den dey try to cope with di bad memory of wetin dem see and experiemce for di joni from naija thru Niger reach Libya and ontop di sea. Den shock when dem find out say di person wen den think say dey carry dem go do beta work for europe na actually trafficker e be. Den do dem anyhow during di joni tru libya sotey dem begin fear for deir life.
– OLIVIAI am fearing I want to die, I want to die because I don't have strength. Dais di only thing in my mind".
– RITAAny small tin now, a little tin like dis now, I will have many problem because wetin I face for dat joni.
Even tho dese women don luckily escape dat life and den don dey live for Germany now, deir madam still dey call dem and deir family dey harass dem for moni. Dese women dey worry say deir madam go harm deir family untop all di suffer wen dem demselves don already chop.
– NORAShe dey threaten my mama for house with ailala say if I no pay her money, say she go kill me, and anytime wen I eventually step my leg for Africa say I no see money give
say I go die.
– TINASo di fear wen I dey fear be say make den no go hurt my parent because my fada den don old, nai be di fear wen I dey fear. make den no go hurt dem, or my brother or sister. Dem go dey threaten dem because me myself, last year I even surprisedwhen den con fit find out where my pipo dey.