Watch A Journey Through Hell Inside dis video seven Naija women wen escape ashawo work for Italy explain di horror of di joni from Naija tru Niger and Libya. Dem abuse dem, rape dem, den even sell dem give men for inside brothel.
Watch Frank, Blessing and Isibor discuss wetin deir eye see afta dem comot for Naija Three Naija men for one migrant centre share deir tory with eachoda. Dem come from different background and get different situation but all of dem travu go Europe thru di same route: Sahara Desert to Libya and las las across di Mediterranean Sea.
Watch Caroline’s story Caroline mama die di day wen den born her, and wen her papa hear di news, heart attack kill am. Wen Caroline reach 12 years old, her caretaker finally tell her say she no get mama and papa. Na for dere Caroline con jam one woman wen cari her go her village to find her true true relative. But afta fight happun for her village, tins get as e be, and life con hard. Na di guy wen Caroline dey date con tell her say hin sista get supamarket for Europe and e fit arrange corret job for her for dere.