Unto awa peer to peer approach, TRS dey work with di Nigerian community wey dey diaspora and also for Naija to taku di rumors and lack of legit information about COVID-19. Local celebrities and influential pipo for di community dey share important messages about COVID-19.
Lolo Cynthia, TRS Supporter from Naija, taku misinformation about COVID-19. Lolo Cynthia na speaker, public health specialist and founder of LoloTalks, a social enterprise with di ogbonge objective to raise awareness about contemporary social and health issues for Africa.
Winnie Martins, singer, author and TRS diaspora supporter wey base for Belgium dey urge di diaspora pipo to folo local guideline inoda to protect demsef from #COVID19.
Temitope Bakare, health specialist and TRS diaspora supporter wey base for Denmark tok about di importance of hand-washing, social distancing and di following of local guideline to helep prevent di spread of #COVID19.