TRS facilitate four meeting with di Nigerian Diaspora wey happun for Italy, Belgium and Denmark. Di events bring togeda diaspora leaders, activists and representatives of diaspora-led organization to discuss di topic of irregular movement.
Di diaspora express deir interest to support di project and dem tok say di project na di first project wey don engage with di diaspora community. Di diaspora also ask for the sharing of alternative legal pathways hand in hand with di awareness raising sessions.