As we dey fight dis COVID19 situation, we celebrate and applaud di roles wey refugees and displaced persons dey play in order to bring change at a time when every body needs help and every action count.
Telling the Real Story applaud all di pipo wey dey contribute toward fighting dis pandemic, , no matter how small. Di pipo wey dey continue to support their communities in any way they can because everyone fit make a difference. Every action count.
Ifrah Ahmed na Somali refugee for Ireland. She create di United Youth for Ireland wey dey provide support to young immigrants for deir business, and deir artistic and creative ambitions. She don also lend her voice to the FGM/C campaign for Ireland and for oda places for Europe where she put her focus for specific gender issue of FGM/C by creating di NGO wey carry her name, The Ifrah Foundation.
26 year old Kiflom Meles na Eritrean refugee for Addis Ababa wey dey use him artistic talent to share information about onward irregular movement. Kiflom discover hin artistic talents for early age and he don continue to pursue hin passion and build hin craft. He dey aspire to paint as often as he fit even though materials dey expensive. When he see moni thru selling hin work, or thru special opportunities dem, such as when he win for di NRC start up support for small businesses, hin buy more canvas and color to paint so dat hin go fit expand hin gallery.
Meron na Eritrean refugee wey dey live for Addis Ababa. Dis na man of many talents, and he dey use hin talent dey uplift fellow refugees as part of shared responsibilities for di community. Before COVID-19, Meron support hin community through his construction and electrical work. During COVID-19, he use hin poetry to raise awareness about the risks of onward irregular movement so that his peers go fit make informed choices. Meron don also produced one drama about irregular movement. Hin motivation na to work on drama wey go fit help young refugees engage with useful activities. Meron ask “Why we no use the opportunities wey dey available for us, instead of to dey go on onward movement…” because hin believe say everyone fit make a difference, and say every action counts.
Lolo Cynthia, na TRS Supporter from Nigeria, wey dey speaks against misinformation on COVID-19. Lolo Cynthia na speaker, public health specialist and founder of LoloTalks - one social enterprise wey dey raise awareness about contemporary social and health issues for inside Africa.
Abraham is na Eritrean TRS supporter wey dey live for Italy. Abraham dey works with refugees. As e be social media influencer, hin dey use hin platform raise awareness about di danger of irregular migration. Abraham dey tell hin story about dangerous joni via Libya..