Franca: They are selling their girlfriends
They are selling their girlfriends
"Di aspect of di joni wey difficult pass nai be where dem dey take dey sell woman, because for di joni, you no know who be who. Man wey you dey with fit sell you, man wey you marry wey dey sleep with you fit just make up hin mind because of advice from friends say... ah, dis woman wey you keep for house so, why you no just sell am make you get 4,000 Libyan dinars?”
Nigerian pipo na one kind persin wen be say dem dey strong minded. If you tell dem say make dem no go, dem go tell you say you don go, you dey tell dem say make dem no go. If di joni no good why you no come back? But seeing is believing, but dat time wey you wan take believe so, e be like mercy after death."