– COMFORTShe say she get somebody wey go fit help me, one of her sisters for Italy. So na wetin cari me comot be dat.
– MERCYDi time wey I dey for street for Abuja, dem dey tok about travu tins. Nai I take meet say me I go like to travu o. Nai e say okay, say hin get persin wey go cari me go Europe.
Before dem begin di joni, den cari di women go swear juju for shrine say if dem run away for Europe sometin go do dem. Wen den leave naija, di joni turn to nightmare. Di traffickers begin abuse and rape dem, na for dere dem con realise di horrible truth say dem dey cari dem go Europe go do ashawo.
– TINANa when we con reach Libya, di place for Libya wen den dey keep pipo to cross, na dere I con dey hear from wetin dem dey tok say dis one na deceive, no be to help again. Na from dere I con dey shed tears.
After den don survive di difficult sea crossing reach Italy, dem cari di women to di place wey dem go work, dem put some of dem for brothel and dem put some of dem for street. Di dream wen dem been get to find beta work jus crash, and di fear of di oath wen den take force dem to jus stay inside di situation.
– LORETTADen no tell me say den wan cari me go do ashawo, den no tell me say den wan go sell me.
– PATIENCEWein den tell me, den tell me say I go come here con dey treat people as a nurse. Den no tell me say I go com dey do road work.
– NORAIf to say e tell me I no go go, I no go move. Becos anytin wen be say say den go dey cari persin dey con dey treat am like slave or prostitution, me I no go put my hand for inside.