– NORAShe dey go Nigeria reach three four times within one year. She dey go dey bring gehs dey come. Since we don comot for Nigerian border nai dis woman con start to dey show us di kind character wen she get.
– RITADi woman still folo me till we started di joni, and wen I see many oppression for road, she don't care to know.
– COMFORTWhen she first tell me say na prostitution I wan do, I been no accept an, she no come dey give me food for house. Then she come begin dey kind of beat me.
All of dese women manage to escape deir bondage but dem still dey afraid of deir madam because deir madam dey use di juju wen den swear dey threaten dem say dem must pay di remaining money wen dem owe.
– MERCYI don’t want to go back to Italy because of that woman. Because if I go back to Italy and e see me, e will told me to coman pay di money.
– NORAShe be very dangerous woman. She said if we no do her biding, even tho we escape, she mus find us.