– RITAShe tell me many tins to do in Europe, e no tell me about prostitute o. She say we will go to Europe, deris many work e will put me. She say di moni e take cari me go dere I must pay her.
Wen dem reach Europe, dem force dem into ashawo, and when dem try to refuse, dem remind dem say dem don swear oath for Naija derefor if dem no do di work wey dey ground, dem go run mad or die.
– MAUREENDat swear wen she use me swear for Nigeria, mai no go kill my enemy. Di fear still dey my body based on wetin e take for my body and everything. Me now no con get any option, I need to dey go road go hustle.
– TINAE dey dangerous becoz di woman cari us swear juju, so I dey fear say I no fit leave, say if I comot, say dat juju go kill me.
All of dese women manage to escape deir bondage, but dem still dey fear to speak deir mind because of di oath wen dem take for Naija.
– TINAI dey fear becos, dos pipo wen cari me so, den very strong for juju issue.
– LILIANFear no let me go because I swear. Anytime wen dat kind tin dey my mind, she go dey tell me say if me try am, me go die.
– JANETSo as she dey tell me dos tins, di tins dey fear me more more.