Antonia na young woman from Naija wen end up for Europe afta terribu waka tru Libya. Antonia mama die when she be pikin so she move go live with her step mama. Her step mama maltreat her.
Antonia run comot for her step mama house at di age of 12. She begin live with one aunty wen promise to take care of her but she end up as nanny and housemaid. Di situation con even worse when di woman brother begin try take advantage of her, so she run go begin live for street.
One day she meet one woman wen promise to take her to South Africa go work for supermarket, Antonia sharply agree. Before di joni den tell her say she must take oath and swear say she no go cari di woman money run odawise she go run mad.
She comot for Naija inside overloaded bus wen cari dem pass through Sahara Desert. For road, men wen cari gun stop dem begin search for moni and begin harass di gehs. Den continue di joni with almost no food and wota, sotey some of dem begin die. When Antonia reach di seafront nai she con realise say di South Africa wen di woman tok na lie, say na Europe den dey go.
Den put Antonia inside one small boat wen pipo full. Di joni ontop di water dey horrible sotey pipo begin sick dey vomit, and some of dem fall inside di sea. When dem reach Italy, Antonia receive call from di madam wen pay for her waka. Di woman tell an say make she come resume di work wen den promise her for supermarket. When Antonia reach di woman place, dem force her do ashawo unto say she must pay back the moni wen she owe.
After Antonia don work di ashawo work for a while, she no fit take am again; so she run escape go Germany. As she dey Germany, she dey hope say the woman no go eva find her again.